09/01/2023
Fact-Check - No be true: Shey dem been sell Bag of Rice Between N7,000 to N8,000 for 2015?
Claim: Former Governor of Niger state, wey him name be Dr Mu’azu Babangida Aliyu tok this one say the time wey dem dey for government wey be government Peoples Democratic Party (PDP) say the time wey dem comot from Office for year 2015, bag of foreign rice na N7,000 go N8,000 for market.
Verdict: This talk no be true because as of January 2015, a bag of rice dey been sell am for N8,100 and for November 2014, bag of foreign rice dey been sell am for N10,000.
Claim
The former Governor of Niger State, wey him name be Dr Mu’azu Babangida Aliyu during the Governorship Flag-off campaign of the Peoples Democratic Party (PDP) wey happen for inside Bida local government, Niger state talk say bag of rice been dey between N7,000 go N8,000 during the PDP’s tenure wey dem dey for power.
Aliyu wey be one of the PDP Chieftains inside Niger state talk say, “Ona don miss plenty because, during we time before, 1 bag of rice na N7,000 go N8,000. Today, now na how much?”
PDP Tenure in Office
The PDP wey been dey rule political party inside Nigeria for 16 years after wey dey win 1999 general elections and President Olusegun Obasanjo wey come from the party enter asso rock as President.
Obasanjo been lead the country for eight years and Umaru Musa Ya’adua come enter after Obasanjo for 2007 alongside Goodluck Jonathan as him Vice. The time wey Yar’adua die for 2010, hin Vice, Goodluck Jonathan come take over and come contest for the 2011 elections come win. Jonathan come remain President until the party lose to the All Progressives Congress (APC) for 2015.
During this period, Dr Mu’azu Babangida Aliyu na im be Governor of Niger state from 2007 go 2015 as him serve two terms as Governor of Niger state.
The tenure for PDP to seatdown for power come end for May 2015.
Price of Bag of Rice Between 2014 and 2015
Although the former governor no gree talk if him dey talk about foreign or local rice o, but doubt Say e feat be foreign rice because for 2015, over 70 percent of rice for Nigeria markets na foreign or the one wey dey import before the importation to ban wey happen for same year.
search been come through the Nigeria Bureau of Statistics (NBS) show say no any selected Food Prices Watch come for 2015. The one food watch price wey dey close pass begin for February 2017.
However, a search through google come reveal say inside November 2014, according to the commodity index make available by Novus Agro Nigeria Ltd inside Lagos on Friday, November 21st, say the price of a 50kg bag of royal stallion and other type wey dey import come na N10,000.
Novus Agros Nigeria Limited na firm wey dey monitors the prices of commodities inside 50 major markets for 25 states of the federation.
Another survey carry out by the same firm from January 2 to 8 show say the same bag of 50 kg bag of rice wey dey import come dey sell am N8,100.
Inside 2013, before before President of the Rice Sellers Association, Daleko Market inside Lagos, Silifat Akinsete as e dey predict ontop increase wey go happen say the price of rice for the second quarter of 2013 disclose say the price of a bag of rice had increase from N8,000 go N12,000.
Verdict: So the claim wey the former Governor of Niger state do na false ontoh the extensive search don shown say dey no sell rice for N7,000 anytime from 2013 to 2015 and for the time wey PDP comot from power, rice dey above N8,000.
Na Niger state fact-check Hub na dem conduct this Fact-Check. The Fact-check dey necessary to ensure say the electorates for the state get real facts by politicians during and even after the campaigning period.