08/10/2024
TOPIC : VIOLENCE , FIRE OUTBREAKS FOR THE COUCIL SECRETARIAT
Rivers State Governor, Wey be Siminalayi Fubara don yan say opposition dey mobilise people to attack and stop the new local government chairmen make dem no start work today. Governor Fubara talk this one as him dey swearing-in the 23 newly elected local government chairmen at the government house,
The governor advise the council chairmen make dem no fight but avoid them.
As una know, kasala burst inside at least four local government areas even some parts of the buildings in Eleme, Ikwerre, and Emohua council premises dey on fire, plenty gunshots happen inside Ahoada East to resist the new council officials. The burning of Local Government secretariats begin happen as police withdraw the police officers from the 23 council secretariats
Former PDP Deputy National Chairman, wey be Bode George, don raise concerns over recent political developments inside Rivers State, say if dem no look am well e go cause kasala for Nigeria and Africa. the elder statesman call on President Bola Tinubu to put body for the mata Rivers State dey too economically and politically important to Nigeria’s survival make kasala no come burst
Presido don tell the police to restore and maintain peace, law, and order immediately, President Tinubu say the judiciary can settle all political kasala,
how you see this mata,
Why e be say we as nigerians go dey destroy government propeties because of election?
Who dey do who?