Area Tori

Area Tori Area Tori🗿
|| Wetin dey shele for we zanga📢
|| Cruise level FL350✈️

Country People......Shey una no go like buy superstar chickiano Ronaldo...E get better footwork if em face jollof united...
02/07/2024

Country People......
Shey una no go like buy superstar chickiano Ronaldo...
E get better footwork if em face jollof united 🙎

Alright O country people....Make we leave matter for Matthias as e no easy for Ezekiel.Today na Gbedu Thursday as Area T...
27/06/2024

Alright O country people....
Make we leave matter for Matthias as e no easy for Ezekiel.
Today na Gbedu Thursday as Area Tori don use front tumble land for ur domot.....Oya Una chop today at all😉 abi una still dey keep fit😁..
Drop ur yarninz mek we know as today Sapele for ur side

AREAAAA People of God e don dey happen for de zanga.... Wahalaa don wear belt as Dr sir portable don dey drag very dark ...
27/06/2024

AREAAAA

People of God e don dey happen for de zanga.... Wahalaa don wear belt as Dr sir portable don dey drag very dark man like generator say howkwana em go dey enter e boss obi cubana. Dr portable say em get better endorsement from em odogwu bitters so why very dark something go dey talk say cubana no provide job opportunities for children of Israel 🤷.
Dr portable don tell am make e put em mouth for em pocket o, say cubana no dey em level to drag o, make e concentrate for Priscilla ojo roundabout 🥱.
Abeg o, e be like na WWE we go watch for this weekend 😁

Bonus advice Mens value appreciates with the time, Women's value deprecates with the time, When she’s 16-20 yrs old “You...
25/06/2024

Bonus advice
Mens value appreciates with the time,

Women's value deprecates with the time,

When she’s 16-20 yrs old

“You’re not my type, I want a rich man “

When she’s 20-25 yrs old

“I don’t date broke men “

When she’s 25-30yrs old

“Serious &real men only, no s*x till marriage “

When she gets to 35-40yrs old

“Do you think it’s every woman that needs a man ?”

22/06/2024

AREAAAA

People of gbedu ministry, how d weekend dey gooo. Una dey sit out abi una go vigil🤌

22/06/2024

Countryyyy Peopplee
OYIBO don carry us handicap again o, see wetin dey do delivery for chinko....Brain too much sotee eh na tinz wey we no expect na em we dey see daily.
My people how una see am...The Steeze dey Steez

21/06/2024

As tinz dey shele for dis we country, e go good o make we know documents wey go gum body join us, mek we nd olopa no come dey drag each other jersey......

20/06/2024

Alright O country people
One sisi wey fine well well don comot come drag shell company dem for dia stakeholders meeting say wetin dem dey do for Niger delta dem community no good. And true true wetin shell don do for the Niger delta communities wey dem done pollute their land?
Make una chook mouth for dis matter make we know if na shell we go blame abi our government.

Alright O country people,Oga davido don drag em baby mama enter i put it to you, say em wey her name na Sophia no get ch...
20/06/2024

Alright O country people,
Oga davido don drag em baby mama enter i put it to you, say em wey her name na Sophia no get chills at all, say e wan dey run am office and not want make e get access to em pikin wey be Imade.
People of God, go buy dictionary because na new new English we go dey hear for court.

20/06/2024

Family go whine you but no panic.
Mama tell em only son to find one bebe give belle for am, say him just dey waste time.

Alright O country people...E don shele for class o as teacher enter em class, see say em student don carry em chair hang...
20/06/2024

Alright O country people...
E don shele for class o as teacher enter em class, see say em student don carry em chair hang for roof. Sabi teacher come use para give Dem test, and d questions e no funny at all.
Oya o class people tear out a sheet of paper for test.
Q1: Calculate d distance wey seperatee the chair wey dey up from the floor, and una go calculate am in centimeters.
Q2: Calculate the angle of inclination of the chair eh, from the ceiling. Dis one go be 15 marks, if una no answer am Una papa.
Q3: Wetin be d student naming ceremony wey carry the chair hang for up? Una get 10mins to submit.
Oya o country people how una see wetin teacher do? Drop ur yarninz for comment section

08/08/2023

Follow Dervickk

Address

Owerri

Telephone

+2348034157984

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Area Tori posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Area Tori:

Share