
24/07/2025
On dis day for 1952, one coup led by di Free Officers overthrow di Egyptian monarchy and end King Farouk I reign.
Di Egyptian revolution start because pipo no happy wit di king, life hard, and wahala full ground.
After Egypt lose di 1948 war, tins worse, and na from dia, di Free Officers group wey Naguib and Nasser lead do coup for July 23 and take over Cairo.
Anwar El-Sadat announce say di army don take control to stop bad govement. King Farouk step down on July 26 and run go exile. By 1953, dem cancel kingship and end di Muhammad Ali family rule.
Di new govment bring big changes like land reform.
Gamal Abdel Nasser later assume full power for Egypt in 1954 and serve as president until im death for 1970.