LAW IN PIDGIN

LAW IN PIDGIN Contact information, map and directions, contact form, opening hours, services, ratings, photos, videos and announcements from LAW IN PIDGIN, Digital creator, Port Harcourt.
(7)

LAW IN PIDGIN
INFLUENCER
REAL ESTATE
I TEACH HOW TO USE SOCIAL MEDIA✅
GHOST WRITER
TEACHER

FOR PROMOTION AND VISIBILITY, DM 07073659503

INBOX ONLY OPEN FOR BUSINESS/CONSULTATION👈

Why person go just use toothpick pick my suya? So, unto night life Waka, I sit down with my husband dey chop suya. One m...
14/09/2025

Why person go just use toothpick pick my suya?

So, unto night life Waka, I sit down with my husband dey chop suya. One man just waka come our table. Next thing, him collect toothpick, collect my suya. The next thing I hear na "Moloje, (my husband nickname), Ibas dey Jones ooooo. You see him thanksgiving"?

Abobi,Wetin concern Ibok-Ete and my suya?

I don tire for Port Harcourt oooo.

Chai! Life na stage by stage sha. We grown from scratch. Thank you my LAW IN PIDGIN family. I ❤ una. Who get una, get pe...
14/09/2025

Chai!
Life na stage by stage sha.

We grown from scratch.

Thank you my LAW IN PIDGIN family.

I ❤ una. Who get una, get person.

Nothing wey I bring wey una no dey support.

I just dey 😭 dey type.

God, thank you as you give me the best followers for social media.

Remember: No relig!0n and Tribe.

Politics? Yes, na me go be the first Female President of Nigeria.

One love. 💕

14/09/2025

Try give your landlord Sunday rice and stew to avoid quit notice. Na so I dey give my landlord. For 10 years now, no quit notice. 😜

"If income comes from both husband and wife, chores must come from both of them too" — Journalist Eloho sparks debate. N...
14/09/2025

"If income comes from both husband and wife, chores must come from both of them too" — Journalist Eloho sparks debate. Na true she talk 📍

For those of una wey dey do 50/50, wetin dey wrong with this statement?

So, when your wife bring 100 k every month and you bring 100 k too as head of the family wey you be, then you expect your wife to do all the cooking, cleaning, bath children, do assignment, nurse children, still give you m0nkey style around 1am.

No na.

This thing dey simple. Marriage dey simple but na people dey make am hard. Marriage sweet if you do the right thing.

If you wan do Oyibo pattern wey be our legal pattern of 50/50, ready to do am. Wetin Law talk na make parents take care of their children. Everything, plus house chores go be 50/50.

If you wan do Bible pattern, do. Take care of your family and make your wife help you. No share bills. Wife help. Husband no share bills.

If you wan do traditional pattern (Odogwu doings) do. Odogwu go provide everything and achalugo go do all the work.

You no go fit dey share bills 50/50 and then expect your wife to do every other thing. No be chea;'ting be that? Na lie. As she dey wash plate, you dey cut onions. 📍

Period!

 Nnamdi    dey sell laptopsFor📖Students 💻Professionals 🖥️Business owners💺Tech/ freelancers There's a laptop for everyone...
14/09/2025

Nnamdi dey sell laptops

For
📖Students
💻Professionals
🖥️Business owners
💺Tech/ freelancers
There's a laptop for everyone!!!

DELL/HP/LENOVO

8/16 RAM
128/256 SSD memory storage
Core i5
7/8/10/11 Gen processors

Battery quality 👌

Touchscreen/Normal screen

Price range
250k - 550k
Based on prescription

SEND A DM INBOX or Ca||
O812 114 137O

Sp0ns0red ads ❗

The kind love and marriage proposal I dey get Everyday, na so other public figures dey get am? Mature man go just enter ...
14/09/2025

The kind love and marriage proposal I dey get Everyday, na so other public figures dey get am?

Mature man go just enter my inbox and you go see "Hi, I need a female lawyer to marry and it's you I want" "Hi, I leave in UK, I want to marry you" "Hello my love, can we link up" Na so una dey do?

I no care whether you dey share long life and prosperity, once you enter my inbox with this kind line, or video call me, I go tell you how irrespon!!sible you dey, then bl0ck you.

N0nsense and ingredients.

You dey find motor to hire for occasion, or any kind of busi!ness, This Sienna motor dey for hire. C0ntact this numbers ...
14/09/2025

You dey find motor to hire for occasion, or any kind of busi!ness, This Sienna motor dey for hire.
C0ntact this numbers wey dey the flyer.

Sp0ns0red ads ❗

 EmmanuelAyofeclothingline – Your Style, Your Vibe! ✨Hey fashion lovers! 💃🕺Are you ready to level up your wardrobe and s...
14/09/2025

Emmanuel

Ayofeclothingline – Your Style, Your Vibe! ✨

Hey fashion lovers! 💃🕺
Are you ready to level up your wardrobe and stay connected with the trendiest streetwear family in town?

Here’s what you get when you f0llow Ayofeclothingline 👇
✅ Exclusive sneak peeks of our hottest designs
✅ Fun updates & interactive content – view and be viewed 😉
✅ Early access to discounts, sales &
give!!aways 🎁
✅ Fashion tips to keep your style on point
✅ Top-quality outfits that turn heads everywhere you go
✅ Airtime givea!!ways on our WhatsApp status every Friday night.
Why just scroll when you can join the family and be part of the fashion wave? 🌊

📲 Follow Ayofeclothingline today – View, Shop & Slay in Style!

🛍️ DMs open for orders & collaborations

Sp0ns0red ads ❗

If Court dey talk to you, whether your be lawyer, client or who just come watch case, you go stand up. Court no go sit d...
14/09/2025

If Court dey talk to you, whether your be lawyer, client or who just come watch case, you go stand up. Court no go sit down dey talk to you, and you go sit down.

Unless na Court tell you to sit down because of your health or age.

Where your land dey? When you bu,y land especially from real estate company or native people, take POSSESSION (Collect) ...
14/09/2025

Where your land dey?

When you bu,y land especially from real estate company or native people, take POSSESSION (Collect) your land.

Possession dey important for land matter.

Some of Una, na Receipt and Deed of Conveyance (ordinary paper) Una b,uy. Una no get any land.

When you bu'y land, take possession (collect your land).

You wey b-uy land for 3 minutes drive from Airport junction for over 1 year now, where your land dey?

You go fit:
1. Carry person go show am your land? Or you be land owner for ordinary paper? Where you land dey?

2. Waka enter your land go start to clear bush, farm, Or build there?

3. You go fit rese|| your land if and when you wan se||?

If you no fit use that land wey you b,uy, them check well, You no get any land. Na receipt you bu,y.

Na so one corper go use girlfriend as Next-of-Kin for NYSC oo. The guy no serve finish him come dye. Na so gi!rlfriend b...
14/09/2025

Na so one corper go use girlfriend as Next-of-Kin for NYSC oo. The guy no serve finish him come dye. Na so gi!rlfriend begin drag the m0ney wey government release with the guy parent say na she be Next-of-Kin. Dey careful when you dey choose Next-of-Kin.

~ from my comment section

Hope, I use my wife as Next-of-Kin but I find out say na her own brother she use for her own. I don talk tire and she sa...
14/09/2025

Hope, I use my wife as Next-of-Kin but I find out say na her own brother she use for her own. I don talk tire and she say e no mean anything.

I say okay.

I tell am say I go change my own use my brother too. Since that day, no pea!ce for house. She say make I use my pikin if I no go use am so that when I kpai, my brother no go come claim my property.

I ask am say why she no use me. She say na me be head of the family.

Abeg, wetin law talk?

Me: who tell some women say na husband go first them kpai?

Oya check comment make you hear wetin law talk👇

Address

Port Harcourt

Telephone

+2348174907818

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when LAW IN PIDGIN posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to LAW IN PIDGIN:

Share