04/07/2023
13 NIGERIAN MUSLIMS DON DIE FOR SAUDI ARABIA
With wetin National Hajj Commission of Nigeria (NAHCON) don talk yesterday, 13 Muslims from Nigeria don die as them go Saudi Arabia for the Hajj.
Dr. Usman Galadima wey be the head of the Medical Team of NAHCON, yan journalists dem on Monday after thee post Arafat briefing for Makkah say “seven Muslims die when Arafat never even start, six die after dem don finish the Arafat (four for Arafat, two for Mina)
“Among the people wey die, four dey private tour while Kaduna and Osun State get two-two wey kpeme. One person from Plateau, Borno, Yobe, FCT, Benue and Lagos na’im die.
“The people wey die dis year plenty pass the people wey die for 2018 (two) and 2022 (two)”.
With tori wey dey reach ToriPost.ng, na over 25,722 Muslims wey get one sickness or the other after dem do the Arafat finish. Men dem reach 10,454 but women wey medical people treat reach 15,268
The kind of sickness wey dem sick for the Saudi Arabia na heat stroke, malaria +++, DM emergencies, and some people wey nut lose for dia head. Some people bin even get chicken pox, but the doctor dem don find way carry dem go hospital wey dey Makkah so that the chicken pox no go spread for dia.
Usman Galadima also talk say two women wey get belle born dia pikin dia. One born for main-road and the other one born for inside the facility wey NAHCON get. Him don advise say make people wey don old stop to dey go the Jamarat and make each state dey carry dia own medical people so dat dem fit stop some Muslim pilgrims wey no well wey dey Hajj
Tori Noble