02/09/2025
kola – that babe wey you vex for yesterday, she too dey talk. Sultana na your guy?
kuture – na my friend, yeah. Wetin happen again?
kola – I feel like she dey talk just for the sake of talking.
joanna – agrees
kuture – you and Sultana get back and forth again? Ogba.
joanna – I no answer am. Na her 2nd cup be that, her 3rd cup dey come. I no get talk to talk with her till she do something directly to me. She dey do am subtle like say she no dey do am. Yesterday was weird, I no even wan talk about am.
kola – no even give am relevance.
joanna – exactly, e no matter.
kola – she just be like person wey go act like your friend now, then go talk another thing with another person about you.
joanna – so na wetin dey occur now?
kola – I no mind make the table sc@tter. At this point, I no even care. A couple of you even pull me to the side to warn me about Doris.
kuture – a couple of who?
kola – I dey my own, Jason, Sultana and Gigi pull me aside. Gigi tell me say Doris tell am to be careful of me, which I find confusing.
Sultana too say Doris dey talk things for people back, she dey tell me make I shine eye because Doris no be who I think she be.
Next thing, I dey see una dey form best friends with her. I come dey feel somehow.
kuture – dem wan put you for middle.
kola – exactly. My own be say, why una go pull me aside to warn me about Doris, then later dey do friendship with her? Now e be like na me distance myself because I no understand who she really
kuture – guy, you gats just go meet Doris one on one. Talk everything wey dey your mind, hear her side. After that, observe her actions.