25/11/2025
Manchester United show say na dem Donald Trump suppose to call disgraced club after Everton use red card take beat dem 1-0 for dem Premier League match wey shele dis night. Idrissa Gana first collect red card for slapping him teammate and just when we begin think say United go use one man down take press their neck naim Dewsbury-Hall use one sweet R2 take make am 1-0 for Everton after less than 20 minutes. United fans wey dey hope for equaliser hope in vain as Everton defend their lead from that first half till the end of the game to make sure say dem finally win United for Old Trafford for the first time in 33 games.
My people how una see dis igbakugba wey United take disgrace their ancestors so?