17/01/2024
😂AFRICAN FUNNY PROVERBS😂...............................................................
⚡1⚡ Na person wey never see problem dey use English dey pray.
⚡2⚡Book wey no gree enter head go enter exam hall
⚡3⚡Goat wey get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.
⚡4⚡Who naked no dey chuck hand for pocket…!
⚡5⚡ Wetin concern dog with family planning?
⚡6⚡Na determination dey make Okada overtake trailer for road.
⚡7⚡This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load.
⚡8⚡Pikin wey go strong go strong…. No be say until dem name am Samson.
⚡9⚡ Na over confidence make February no complete.
⚡10⚡Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.
⚡11⚡Head wey no wan think, go carry load..
⚡12⚡Hand wey stay long for pocket, know say nothing dey that pocket.
⚡13⚡forget Trust If trust dey, Water no for boil Fish.
⚡14⚡Na wen visitor chop finish for your house im dey remember say rain don fall finish
⚡15⚡ I hear nor mean say I agree
⚡16⚡No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile.
⚡17⚡E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching take start.
⚡18⚡ Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control.
⚡19⚡Escort me, es**rt me naso slave trade take start.
⚡20⚡It’s a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.
⚡21⚡ Christianity is free, but you must buy Bible
⚡22⚡ Person nor dey use shame chop winch o
⚡23⚡Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.
⚡24⚡You no need spoon and cutlery to chop slap.
⚡25⚡Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
⚡26⚡ The patient dog … Nah hungry go kill am.
⚡27⚡ I go do am later na e make fowl no fly like other birds.
⚡28⚡No food for lazy man no be for person wey em mama get restaurant.
⚡29⚡Who dey hold landlord rentage no dey fry stew wey curry dey.😁😁😁😁
FOLLOW 👉Chi SomChi Som