25/09/2025
🚨 Men wey no dey keep koboko for one place, look this babe well 👀… you like wetin you dey see abi? Better shine your eyes, because after this gist, you go understand why e dey important to dey very careful!
Meet Richard and his long-time friend, George. George call Richard one day say he wan sell land. Richard wey be Vice President of Real Estate Association for Bayelsa quickly find buyer, and dem close deal for ₦9 million.
George collect the money but when dem ask for land papers, he talk say he forget am for house. Richard, trusting his guy, stand guarantor. Two days later? No papers, only excuses.
Then wahala burst. George’s side chic, Tee Salvage, call Richard say make he meet George for hotel with the papers. Richard go… but he no return home. His wife dey panic, but Richard dey reply chat claiming say deal go wrong and he dey hide. Meanwhile, George don run police station dey form innocent, claiming he refund ₦9m to Richard.
Chairman of the association trace matter go George’s land. A farmer warn am say he hear three gnshts that night and even jot down the number plate wey leave the land. Police trace am – na George motor!
Further diggings show say George don send ₦1m to Tee Salvage. Police rush her house, catch her packing luggage to relocate. Inside truck dem find weapons, including the very k@la wey dem use kpai Richard.
George sef was caught trying to flee the country. Investigation reveal say he and the side chic dey work hand-in-hand to lure and finish people. Their next target? Richard’s wife – just to cover up their crime.
And guess what? George get wife at home o, while Tee Salvage na just s!dech!c. E mean say dem don use this same method for others before – luring men with fine b@b€ online, only to end their story.
⚠️ Lesson: no be every slay queen wey shine online be normal babe. Sometimes na full setup. Men, protect your koboko and shine your eye!
📌 Credit: VeryDarkBlackMan