07/10/2025
Please learn from this story🙏
Omo, I just dey laugh boys wey go do anything for money, dem never know anything about life. Me sef no holy, at the lowest point of my life, I was tempted to do things, but I remove face.
There’s no young man wey never meet friend wey go tell am say make dem enter location, My guy wise up, D€v!l no dey give without collecting something better from you.
I remember 2013, Sapa wan finish me and my guys. One of my guy let’s call him Akala. Akala dey ginger us say we don too suffer, say make we enter location. Another of my friend, let’s call him Gadus. Gadus dey agree with Akala say we don too suffer, say make we enter location.
Naso Akala come house one day say he don see location wey we go enter. We con talk say we go enter there on Tuesday. I say I no wan go, but Gadus deh tell me say I no get mind. Finally, I agree to go.
One the Tuesday wey we suppose go, Gadus tell us say make me and Akala go, say he go meet us for the place. Brothers and sisters, Gadus never came. Finally na me and Akala go that place.
That was the first and last time I enter Babalawo house for my life. When we reach there, Baba ask Akala wetin he want, Akala talk say he want make god bless him Yahoo.
🤣 Wetin I tell Baba say I want go weak Una, but I swear, that’s what I said. I tell Baba say make he do something wey go make me dey see the scores of football matches before dem play am, so I fit dey win Nairabet. You know say ma only Nairabet dey back then 😂
Baba con tell us say we go need do cleansing, say make we bring 15k each make he take get the materials wey he go use do the cleansing. Yo, 15k was big money back them for us wey dey suffer 😂😂
When I went home, I con dey think say; what if Baba bath us finish for dustb!n, con bvry the sponge for road junction, what if my life no con dey move tomorrow and dem tell say na that sponge wey he bury dey affect me ? 😂😂. Because na wetin Baba be tell us say he wan do be that.
My people, just like Nollywood, may God continue to bless that woman anywhere she is. I was walking to the Jamb lesson wey I for dey teach. I was walking along the road in Virginia street, 2nd east circular road, Benin city, when one woman called me.
She was sitting in front of her house, she asked me a question. She said “where you dey hurry go?”. I didn’t understand, I said I dey hurry go work, then she asked again, “where you dey hurry go for life?”.
She told me to be patient, not to go further with what I wanted to. Na then I fe@r o. Honestly, I think say na only movies that mind thing dey happen. I kn€lt down and she prayed for me. Naso I take remove body from that matter.
Akala went ahead to do it. He moved out of my place and later I hear say he don travel to South Africa, dey ball, even buy Corolla.
But later, I hear say he don dey talk wetin no follow road, he go dey talk say he dey see black bird. I no con know how far him life dey right now.
But I never looked back, face my God and my life. As a Christian, I believe say Jesus na the way. But i have close Muslim friends and I respect their religion as well.
Whatever you do in life, whatever religion you practice, Abeg no try cut corners. Anything juju no dey end well. Na tr@p, don’t fall for it. I hope some people have learnt from this my story. May God continue to direct us.