
14/07/2025
W/ Okiemute Ruth Bello, Isaac Laurie & Owo Ernesto II
Di Sole Administrator of Rivers State, Ibok-Ete Ibas, on Monday don swear in di new people wey dem appoint to lead di Rivers State Independent Electoral Commission (RSIEC).
Dem include Dr. Michael Ekpai Odey as Chairman, wit six other members: Mr. Lezaasi Lenee Torbira, Professor Arthur Nwafor, Professor Godfrey Woke Mbudiogha, Professor (Dame) Joyce Akaninwor, Dr. (Mrs) Olive A. Bruce, and Professor Chidi Halliday.
President Bola Ahmed Tinubu don declare seven days national mourning to honour former President Muhammadu Buhari wey die on Sunday.
Tinubu talk say make all national flags for di country dey fly half-mast for seven days starting from Sunday, to show respect to di late leader.
- How una see di matter ?