Glees Naija

Glees Naija Your Number 1 Pidgin hub for:
📍Update ✅
📍Entertainment ✅
(5)

Happy 17th birthday, Aunty Success. Of Mark Angel Comedy🎉 ⭐️
19/07/2025

Happy 17th birthday, Aunty Success. Of Mark Angel Comedy🎉 ⭐️

😂 Tyla too slim, the trouser dey use prayer dey hold her waist 😭😭Person talk say she fit use earrings as belt 😭😂This bod...
19/07/2025

😂 Tyla too slim, the trouser dey use prayer dey hold her waist 😭😭

Person talk say she fit use earrings as belt 😭😂

This body na XXS with correct vibes and Grammy inside oh!
No flesh, just pure talent and steady drip 😅🔥

If you blow breeze near Tyla, she fit vanish o 😭
Abeg make una help hold her trouser before e fall 😂😂

🔥 “Na dem get English — so wetin go make me dey try sell am give dem?” – Phyno 🗣️🇳🇬One time like dat, Phyno bin dey rap ...
19/07/2025

🔥 “Na dem get English — so wetin go make me dey try sell am give dem?” – Phyno 🗣️🇳🇬

One time like dat, Phyno bin dey rap for English, dey find him own way.

But e later ask himself one correct question:

“If I wan sell give the world, wetin I get wey dem no get?”

Na dat moment e reason well…

👉 “I no fit waka go UK go dey sell English — na their own be that. But I fit sell Igbo… my culture, my originality. Na there my power dey.” 💯

From that day, Phyno follow him own lane — and today, e don become one of the biggest Igbo artists for this life 🌍🔥

📌 Wetin we learn from this? No dey copy dem if you wan stand out. Just be original sotay dem no go get choice than to respect your difference.

🚨😂 "YOU NO BE MY PAPA!" — Carter Efe pikin deny am TWICE for livestream! 😳😭Carter Efe ask him small daughter, Charis, sa...
19/07/2025

🚨😂 "YOU NO BE MY PAPA!" — Carter Efe pikin deny am TWICE for livestream! 😳😭

Carter Efe ask him small daughter, Charis, say:
"I be your papa?" — Wetin she reply?

"No!" 😭😭
And she no talk am once oh — she talk am TWO times! 😭😂😂

Carter try form strong face, but internet no gree let am rest! Reactions don full ground:

👤 🫥🦋🍡: “After this video, Carter fit don go do DNA for back without tell the mama 😂😂😂”
👤 : “Dem don dey tell you truth since bro 😂😂”
👤 .C.M: “Carter first think say na joke oh 😂😂”

This one really weak us abeg! 😂
If na you, you go believe the pikin or go do DNA sharp sharp?

Drop your own reaction for comment section 👇💔😂

🚨HISTORY DON SHELL ‼️🔥Enzo don become the FIRST Nigerian streamer wey perform live with Davido for stage! 🐐🎤Na for July ...
19/07/2025

🚨HISTORY DON SHELL ‼️🔥

Enzo don become the FIRST Nigerian streamer wey perform live with Davido for stage! 🐐🎤

Na for July 17, 2025, during Davido “5IVE ALIVE TOUR” for Toyota Center, Houston — na im the big miracle happen…

🎥 Popular African streamer Enzo first no fit enter backstage — dem bounce am!
But guess wetin happen? Davido and him team later carry am come stage with full love ❤️
Dem give am space to SHINE like star 🌟

E no just show face — ENZO PERFORM LIVE!
The whole crowd craze scatter! 🔥🔥🔥

📌 From pressing stream for house to now dey share stage with the biggest Afrobeat king — Enzo don break record for all African content creators!

Big congrats to you, King 👑🎉
You no dey stream again, you dey write HISTORY.

Tag any Enzo fan below 👇❤️

💔 “Dem Pursue Me for Midnight Because I No Fit Pay House Rent” — Maurice Sam 💔😭“I cry tire anytime I remember dat my dar...
19/07/2025

💔 “Dem Pursue Me for Midnight Because I No Fit Pay House Rent” — Maurice Sam 💔😭

“I cry tire anytime I remember dat my darkest moment. Na my close padi throw me comot for house around midnight… just because I no fit drop my own share of the rent. Life hard that time pass anything — I even work for filling station as pump attendant just to survive. But even that one no reach to meet my needs — I comot the job go chase my dream.

Na acting save me. I pour my whole heart inside — sleepless nights, hunger, cry — until grace locate me. Today, the same people wey ignore me that time dey clap for me.”

📌 No ever give up on yourself. That your pain fit be the beginning of your success story. Congrats to you, Maurice Sam! 👏❤️

😳 Adekunle Gold don dey with Mia Khalifa for Paris 🇫🇷❤️Two big names from totally different corners — but somehow, dem j...
18/07/2025

😳 Adekunle Gold don dey with Mia Khalifa for Paris 🇫🇷❤️

Two big names from totally different corners — but somehow, dem jam for city wey dem dey call city of love! 💫

Fans don dey ask: Na just normal hangout… or something romantic dey cook for back? 👀🔥

Paris no go hear word this week oh! This gist go scatter internet! 😂😂

👉 Wetin you reason? Na collabo be this or love dey involve? 💭❤️

🚨💍 BREAKING NEWS: 18-Year-Old Real Madrid Baller Endrick Don Marry Him 24-Year-Old Babe 😱❤️Love don blind age finish oh!...
18/07/2025

🚨💍 BREAKING NEWS: 18-Year-Old Real Madrid Baller Endrick Don Marry Him 24-Year-Old Babe 😱❤️

Love don blind age finish oh! After just one year wey dem date, Endrick and Miranda don do wedding sharp-sharp 💒 — and guess wetin happen?

👉 No be say Endrick just marry her — baba carry all him £12 million fortune enter joint account to prove say him love and trust her scatter! 🫢💰

Just 18 years old, but the guy dey show say true love still dey this life. No prenup, no shakings — na pure vibe and deep love 💞🔥

🙌 Men like this scarce well well for this generation!

BIG MOVE FOR SOUTH-EAST IF DEM DO AM WELLPresident Bola Tinubu don approve one better investment plan for South-East wey...
18/07/2025

BIG MOVE FOR SOUTH-EAST IF DEM DO AM WELL

President Bola Tinubu don approve one better investment plan for South-East wey go boost industrial growth for the area.

Wetin dey inside the plan na:

🔧 South-East Development Commission (SEDC):
Tinubu don sign law for July 2024 wey go set up this commission. Dem go handle rebuilding and repair of many infrastructure wey suffer during Biafra war time, and also push better development and economy change for all South-East states.

🚧 Better Infrastructure Projects:
Apart from wetin the commission go do, Tinubu also approve federal road projects for South-East. Some of the major roads dem mention na:

Port Harcourt to Enugu

Enugu to Abakaliki

Enugu to Onitsha

Onitsha to Owerri

💼 South-East Investment Company (SEIC):
To ginger business and industrial growth, Tinubu still approve one special company called SEIC. This one go focus on bringing more investment into the South-East.

👨🏽‍💻 Focus on Youth & Skill Development:
Dem still dey plan to train young people with digital skills, help dem start business and create jobs. This one go benefit South-East youths well-well.

All these plans na to solve the plenty wahala wey don dey face the South-East for long. If dem really do am well, e go bring better road, more jobs, more money, and better life for the people wey dey there.

🕯️ THE UNTOLD STORY OF MR. IBU DE@TH 💔Dem make everybody laugh… but him d!e with pain for him heart.Jasmine no be just M...
17/07/2025

🕯️ THE UNTOLD STORY OF MR. IBU DE@TH 💔

Dem make everybody laugh… but him d!e with pain for him heart.

Jasmine no be just Mr. Ibu adopted pikin — na pikin of him soldier friend wey don kpai. After her papa d!e, Mr. Ibu carry her like him own, train am, even send am go school for abroad.

Then for 2020, Jasmine receive one WhatsApp message:

“Abeg help… Daddy need you.”

She think say na scam, but when she check well — na true. Mr. Ibu dey s!ck, bróke, and nobody dey around am. Even family no show.

Jasmine fly come back, rush am go hospital, take care of am like real pikin.

Na for hospital bed Mr. Ibu tell her:

> “Dem wan finish me. Even my wife don turn back on me. I no get peace for this life — not for my house, not for my marriage.”

Na so he take d!e with broken heart. No be only sickness — but from how dem neglect and betray am.

Now everybody dey shout “RIP”… but where una dey when he need una?

🕯️ Drop candle for Mr. Ibu if this thing touch you. Rest well, legend. Your laughter go forever remain. 💔

"Who dey style Ayra Starr like dis??" — One concerned fan don shout after dem see her new photos 😫🙆🏻‍♂️
17/07/2025

"Who dey style Ayra Starr like dis??" — One concerned fan don shout after dem see her new photos 😫🙆🏻‍♂️

🔥 Viral photo of dancer PurpleSpeedy don scatter everywhere! 🙆🏻‍♂️👀🏃🏾‍♂️"Everywhere just tight like Naija economy!" 😭😭😭I...
17/07/2025

🔥 Viral photo of dancer PurpleSpeedy don scatter everywhere! 🙆🏻‍♂️👀🏃🏾‍♂️
"Everywhere just tight like Naija economy!" 😭😭😭

Internet no gree rest — comments dey fly like dollar rate 😂💸
PurpleSpeedy no come joke at all o! 🔥😅

Address


Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Glees Naija posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Shortcuts

  • Address
  • Alerts
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share