Matters Arising

Matters Arising Matters Arising is a platform to raise issues affecting our people with a bid to proffering Solutions

Happy 38th Anniversary Akwa Ibom, the entire   Team wish the state more Joy, Peace and Development for the years ahead. ...
23/09/2025

Happy 38th Anniversary Akwa Ibom, the entire Team wish the state more Joy, Peace and Development for the years ahead. Today, go dey on top PASSION 94.5 FM, UYO from 3:00pm - 4:00pm, and to celebrate the states, ogbonge gifts dey for our listeners.
Post your photo wey you wear Akwa Ibom attire for the comment section, make your friends like the photo. People wey get the highest engagements go win prizes.

E nor get as Rain wan fall reach for Monday Morning wey man pikin no go ARISE go make sumol money put for pocket, and fo...
08/09/2025

E nor get as Rain wan fall reach for Monday Morning wey man pikin no go ARISE go make sumol money put for pocket, and for We don waka go bring the Oga Kpata-Kpata for Ibom-LED and Sole Administrator for Ibom Paint; Mr. Ime Uwah, land for the studio. Remember say last year, Ibom-LED train some people, our Governor Pastor Umo Eno con give them some money to take start-up the business wey dem train on top. Now, time don reach for new batch to follow enjoy this same training. How person fit register, who fit register, when dem go register, how i fit take enjoy the training plus all the other many-many kweshun na e we wan ask am for the show. Tune to Inspiration FM 105.9 from 11:00am make we follow shook mouth for

My Pipo, Una Welcome to the Month of September, na end of the year we don dey go so, the Month go pure for all of us. To...
01/09/2025

My Pipo, Una Welcome to the Month of September, na end of the year we don dey go so, the Month go pure for all of us. Today for na the Honorable Commissioner of Sports Elder Paul Bassey na e go by our guest, we dey hear many talk about the Akwa Ibom Sports Festival and na e go come torchlight the matter deep-deep, make we all for understand am. Tune in to Inspiration FM 105.9 for 11am, make we for reason this matta we consign we pipo.

As Monday don reach like this, you sabi say time for   don reach. This weekend wey pass so, Governor of Akwa Ibom State ...
25/08/2025

As Monday don reach like this, you sabi say time for don reach. This weekend wey pass so, Governor of Akwa Ibom State Pastor Umo Eno complete e tour of the 10 Federal constituencies wey e tag "Town Square Meetings". Na for Etinan Federal constituency the the final-final take place, and na why we bring the Member representing that zone for the House of Representatives; Obong Paul Ekpo come siddon to recap wetin the demands of the People be, How the townsquare go and how e go fit take shook hand to helep the people of Akwa Ibom, live better. Tune in to Inspiration FM 105.9 at 11:00am for

For everything wey government dey do, if e never touch the people, then dem never do anything. Nah why today na for the ...
18/08/2025

For everything wey government dey do, if e never touch the people, then dem never do anything. Nah why today na for the Honourable Commissioner, Ministry of Humanitarian Affairs, Akwa Ibom State. Princess Emem Ibanga nah our guest for this morning for Inspiration FM 105.9. Join us from 11:00am.

My Contiri Pipo, This weekend wey pass na the turn of Uyo Federal Constituency Townsquare meeting. Every-every been waka...
11/08/2025

My Contiri Pipo, This weekend wey pass na the turn of Uyo Federal Constituency Townsquare meeting. Every-every been waka go Ibom-Hall, where the Governor come meet with e people, to ask them wetin dem want ahead-ahead inside the ARISE Agenda. Chairman of the Media and Publicity Committee, Rt. Hon. Dr. Aniekan Uko na e go be our guest as we go ask am how the thing go down, wetin the people ask Govo, and wetin be expectations and timeline for these promises. Tune in to Inspiration FM 105.9 from 11:00am, on top , your questions and observations dem sef welcome for the show. No Miss am.

Make we talk digitalization of the Akwa Ibom government this morning on   as Hon. Frank Ekpenyong wey be commissioner fo...
04/08/2025

Make we talk digitalization of the Akwa Ibom government this morning on as Hon. Frank Ekpenyong wey be commissioner for Ministry of Science and Digital Economy go siddon for the hot seat. How payment of salaries, allowances, employment of new staff for Civil service, and contractors take dey access the portal and how you sef wan take benefit? Tune in for Inspiration FM 105.9 today from 11:00am, as we begin discuss issues wey concern our everyday Pipo.

Our People say "Build the Youths, Build the Nation" na why we carry the Man wey Akwa Ibom State Government give the resp...
28/07/2025

Our People say "Build the Youths, Build the Nation" na why we carry the Man wey Akwa Ibom State Government give the responsibility to hold the Youth Development side for inside this Administration; Dr. Ekerette Ekanem, we be the Hon. Commissioner for Youth Development. He go con follow talk wetin the role of the youths be, the programs wey dey ground to benefit the youths and how far we don waka on top Youth matta. So if building the Youths cocern you, then tune in to Inspiration FM 105.9 from 11:00am on top . Follow shook mouth with your comments and contributions. Youth Matter concern all of us

Address

Uyo
23401

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Matters Arising posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Matters Arising:

Share