Matters Arising

Matters Arising Matters Arising is a platform to raise issues affecting our people with a bid to proffering Solutions

08/06/2026

We are live... join us

  don return this Ogbonge Monday morning, to toshlight the matters we concern we everyday pipo. Today, na the Power and ...
08/06/2026

don return this Ogbonge Monday morning, to toshlight the matters we concern we everyday pipo. Today, na the Power and electricity side we wan look, where Hon. Iniobong Robson, the Commissioner for Power go come clear our doubts as e take concern electricity for we state. Who be the commissioners wey dem appoint? wetin their work go be? When Akwa Ibom people go begin enjoy the light yanfu-yanfu? Tune in to Inspiration FM 105.9, from 11:00am for

01/06/2026

We're live... join us

My People dem, una welcome to the Month of JUNE!!! We pray say as Matters dey rise, Papa God go give solution to all, fo...
01/06/2026

My People dem, una welcome to the Month of JUNE!!! We pray say as Matters dey rise, Papa God go give solution to all, for we state and we country; Nigeria.

Today for , we dey look the 3 years of the current administration of Pastor Umo Eno, especially the projects dem wey we fit touch and relate to the people. If you carry eye look the Youth Development Centers wey dem don begin launch, you fit begin ask, wetin dem be? wetin dem dey for? how people for every corner of the state fit benefit and wetin we go expect to see for there. Join Dr. Frank Ekpenyong; the Honourable Commissioner, Ministry of Science and Digital Economy on top for Inspiration FM 105.9, from 11:00am as e go answer all these questions and many more.

25/05/2026

We are live

18/05/2026

is LIVE!

Contri Pipo, as 2027 dey near us, na so Political parties dem and politicians dey waka from corner to place, to impress ...
18/05/2026

Contri Pipo, as 2027 dey near us, na so Political parties dem and politicians dey waka from corner to place, to impress the pipo, show scorecard, and tell us wetin dey more as we dey follow go. Today, the Political Adviser to Governor of Akwa Ibom State, Dr. Godwin Ntuk Udeh na e go our guest for , e go helep us explain wetin direct primaries, consensus candidate, and the timetable of the ruling political party. We on the other hand, we go ask am, wether this politics dem no go affect the governance promises wey full ground so. Tune in to Inspiration FM 105.9 from 11:00am this morning as we dey siddon to reason matters we concern we everyday pipo.

11/05/2026

We're live

11/05/2026

Join us

Tourism dey carry people go places, make dem see things, and experience life wey dem never see before, and for Akwa Ibom...
11/05/2026

Tourism dey carry people go places, make dem see things, and experience life wey dem never see before, and for Akwa Ibom state na one of the ogbonge drivers wey the government take dey drive e ARISE Agenda. As you sef sabi say Monday moh-moh na e we dey choose to reason matta dem wey concern we everyday pipo on top , join the MD of Akwa Ibom Destination Management Office;Lady Stella Fubara, as she go con tell us how far the waka dey go, how we as people fit shook body-get benefit, and answer we questions concerning the movements for we state.
Tune in to Inspiration FM 105.9 from 11:00am for . No Miss am!!!

Address

Uyo
23401

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Matters Arising posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Matters Arising:

Share