27/05/2026
With Kate Ogan
" Pray make bandits and terrorists change from their bad ways," Presdo Tinubu dey tell Nigerians.
Presido Bola Ahmed Tinubu dey beg Nigerians make dem pray for bandits and terrorists so dat dem go stop their evil Doings. E still tok say him government no go rest until insecurity mata finish for di country.
For eim Eid-el-Kabir message, di President wish Muslims happy celebration con tell Nigerians make dem embrace sacrifice, unity, compassion, and make dem dey selfless.
Tinubu tok say eim know say terrorists and bandits still dey attack some communities even wit wetin security agencies dey do. e still tok say goment go continue work to bring back peace and protect we pipo of Naija.
" Pray make those pipo wey dey do crime for we contry change der mind, leave der evil ways, if not law go catch dem," Presido na eim tok dat one.
E also talk say e get hope for di economy, say di new things wey eim government introduce don dey bring good results small small.
📌How you see dis talk wey Presido yarn ?