09/04/2026
"No be 10 people t0uch DJ Tunez, na only me and na only two sl@ps I give am. I sw£ with my mama, if I dey lie, make 0gun carry my mama go anywhere wey Wizkid’s mama dey. He come go dey tweet, I think say he go send squad, na internet their own power dey. We na real life our own power dey.
I tell people make them no t0uch am. Na only me t0uch am. If say 10 people t0uch am, na so him go dey? I even think say him go call their oga, their oga wey go do something. But na tweet him oga come dey tweet. So what was the point, that means I don waste my time...."
– Nigerian music star Burna Boy has addressed the recent incident involving DJ Tunez, offering his version of events, while throwing shades at Wizkid.