08/06/2025
Flood don full Lagos.... AGAIN!!!
Over the past couple of days, videos have been flying up and down online, serious flooding in Ikorodu, and Lekki Lagos. And I’m not just talking about gutter water overflowing. I’m talking about full-blown flood; houses flooded to brim, shops under water, cars half-submerged. People literally queuing just to pass through one tiny overhead bridge like say na immigration checkpoint.
Whatarewedoingsef?
Now, I go talk true, this kain thing no even shock me again. It’s almost like a yearly tradition in Nigeria. Rain go fall, drainage no go work, everywhere go flood, and life continues.
But you know the part wey dey pain me pass? Na how we go still dey laugh about am. Nigerians go turn am to joke.
Videos with background music, memes, skits. We go dey smile through suffering. And that’s one big reason our leaders no dey take us seriously.
Because if this kain thing happen in a country like the U.S., people go raise alarm. Emergency numbers go dey hot. Local authorities go swing into action sharp-sharp. But for here, we don normalize disaster. We no dey vex enough.
Tell me,
what’s the job of the Commissioner of Environment?
Wetin Minister of Environment dey do?
All the billions wey dem dey allocate for environmental safety na only for paper? How many times we go talk this same talk before something changes?
See, until we begin take ourselves seriously, the government no go take us seriously. We dey face the same problems every year, and e don tire person.
So again, I dey ask; whatarewedoingsef?