Comedian Native parrot

Comedian Native parrot BEST VIDEO EDITOR

BEST AND PROFESSIONAL FACEBOOK COACH

WHATSAPP NO: 07049521454

TRAVELER

BUSINESS MANEGER

YOUTUBER

ACTOR

For this life ehn, make we no lie, e dey very hard to dey connect with celebrities when you never buildd your own brand....
08/12/2025

For this life ehn, make we no lie, e dey very hard to dey connect with celebrities when you never buildd your own brand.
No be say dem wicked o, but truth be say, if you never get your own name for street, the connection go always get one kain gap. Aside from money, the real wahala be say you never get wetin go make dem see you as their level. And for Naija here, everybody dey chase value…. if you no get am, dem no go notice you.

But guess wetin? The moment you build your own platform and turn yourself to brand wey people dey respect, na you go begin dey surprise.
Those same celebs wey dey look you from far before, go begin dey come close, dey hail you, dey even find chance to gist with you. Na so life be. When you get your own shine, everybody wan tap from am.

That’s why e good make you focus on your own lane. Work on your craft, build your influence, let people sabi your name for the right reason. No dey run after clout, dey build your own.
Because when your light bright, e go shine reach people wey you never dream say you go meet.

My people, Na better thing dem dey celebrate. No be empty noise, but results. Once you win for your own corner, every other thing go just follow ……connections, respect, and opportunities go dey rush you. Hustle smart, shine steady.

My people, make I yarn una true talk. I don notice say plenty of una don pause posting for more than two weeks now just ...
08/11/2025

My people, make I yarn una true talk. I don notice say plenty of una don pause posting for more than two weeks now just because views low. Especially my fellow new content creators, e no suppose be so o! You see this content creation work ehn, na consistency be the koko. No be every post go blow immediately, but that no mean say make you stop.

So far as you dey healthy, your phone dey work, and your mind dey sound, abeg keep dropping your content. Sometimes, the video wey no move today fit suddenly go viral next month — na so algorithm dey play. You fit just wake up one morning and see say your old post don blow like harmattan fireee.

Low views no mean say your content no good; e just mean say your time never reach …… but e go reach, I swear. Na small-small be the thing. Every big creator you dey see today don pass through this same dry period.

So no dull, my gee. Post today, post tomorrow, keep showing up. Remember, na who stop posting lose completely. Your own viral moment dey come, just hold body.

Make I help you small, may be you don’t know this one.See ehn, before you enter this content creation street, you gats f...
08/11/2025

Make I help you small, may be you don’t know this one.
See ehn, before you enter this content creation street, you gats first develop thick skin and strong heart wey fit carry insult like say na free gala. Internet no get joy, people wey no sabi you from anywhere go just dey drop negative comment like say na their side hustle. Even your friends and family fit join drag you if you no stand well.

Make we use Nkubi as example. If you check him comment section, e go shock you. People dey bash him wife, even the small pikin wey dem just born. Dem no dey reason say na human beings dey that side o, dem go just type anyhow from the comfort of their phone. Some go talk am subtle, some go drop am raw.

This na the real face of content creation — e sweet, e shine, but e get pepper wey dey burn. If your heart no strong, you go just log out disappear. People go test your patience, dem go try make you vanish. But if you gree stand strong, you go still dey smile and deliver content wey go scatter everywhere. Na only strong mind fit survive this hustle.

Last last, everybody go cash out for this content creation hustle. No rush am, no compare your journey with another pers...
08/09/2025

Last last, everybody go cash out for this content creation hustle. No rush am, no compare your journey with another person own.
Na steady grind, small small improvement, and plenty consistency go make the money and recognition show.
For this game, patience na key — because e sure for me say as long as you dey put out quality work, dey stay authentic, and dey connect with your audience, the results go come like new alert for phone.
No let pressure from social media make you lose focus. Just dey create, dey learn, dey grow. Na so e dey be — last last, all of us go smile reach bank.

When setting up your payout on Facebook, avoid guessing or trying to figure it out blindly. Instead, reach out to your f...
08/08/2025

When setting up your payout on Facebook, avoid guessing or trying to figure it out blindly. Instead, reach out to your favorite coach or someone experienced who truly understands the process.

It’s not about how many followers they have—some influencers may be popular but lack the technical knowledge to guide you.
Make sure to discuss and agree on the help you need. Getting expert guidance can save you time, stress, and potential mistakes.

Some of you have individual TIN but you already hang your page in business please act on time, don’t t contact me after you have spoil things and complicate issues.

08/08/2025

THIS IS HOW TO EDIT THIS TYPE OF AMAZING VIDEOS.

08/07/2025

THIS IS THE BEST AND EASIEST WAY TO DOWNLOADD PEOPLE VIDEO ON FB VERY FAST NO STRESS

Evidence full ground but sometimes I think is not yet time to show it.This was my comment under MC Mbakara’s post, 4 yea...
08/06/2025

Evidence full ground but sometimes I think is not yet time to show it.

This was my comment under MC Mbakara’s post, 4 years ago. I kept trying to see if I can get to ordinary 100 followersss as at then.

But I just had only 68 followers in three months, it was very very hard and my mind then was not shaking because I believe.

I hit violationnn that started affecting my page when I had 3k followersss but I did not quit, I kept persisting, I kept asking God for His amazing Grace.

Today I’m not counting followers, By God’s Grace upon me I have build people, I can proudly say it and that is my greatest achievement.

So for those of you comparing MC Mbakara’s engagement to your own, be careful those are men that have spend 10 years or more in industry before you.

Don’t pressure yourself, don’t compare people or yourself, eget why.
If you did not quit you must win 🏆

08/06/2025

THIS IS THE SITUATION OF THIS PETSON PAYOUT, BECAUSE OF SOME CERTAIN MISTAKES HE MIGHT HAVE MADE.

08/06/2025

Do this to any content you want to carry to your page

PLEASE YOUR UNDERSTANDING IS NEEDED DON’T QUOTE ME WRONG.What I see in my messages every day is 👉 ( PLEASE SIR I NEED YO...
08/05/2025

PLEASE YOUR UNDERSTANDING IS NEEDED DON’T QUOTE ME WRONG.

What I see in my messages every day is 👉 ( PLEASE SIR I NEED YOUR HELP, TEACH ME HOW TO CREATE CONTENT OR THEY WILL SAY MONETIZE MY PAGE FOR ME.)

Please do not message me privately expecting free lessons or asking me to help you monetize your page without payment.
It’s inappropriate and shows a lack of respect for my time, skills, and experience. I’ve worked hard to gain the knowledge I have.
The lessons I drop here on fb is free and very very useful, so once you are coming my dm be aware of what you are coming for or learn here on facebook which is free.
If you truly value what I do, approach me professionally and be willing to invest in the value I can provide. Let’s respect each other’s work and boundaries.

Start with what you have—don’t wait for the “perfect” gear. I began my content creation journey with an Infinix Smart 5....
08/05/2025

Start with what you have—don’t wait for the “perfect” gear. I began my content creation journey with an Infinix Smart 5.
It wasn’t fancy, but it was manageable for till I borrowed from somewhere and bought iPhone 7.

Today, I can afford better phones, but that humble beginning taught me creativity, patience, and progress. Don’t underestimate your current tools. Just start. Improve as you go. Your story, passion, and persistence matter more than your equipment. Keep creating!.

Address

Charleston Court
Winston-Salem, NC
27103

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Comedian Native parrot posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Comedian Native parrot:

Share