01/08/2023
Me: Bro, hwfa...see when you dey come back house
Solomon: Mtchew...*flings nylon on the bed and sits down*
Me: Baba wetin happen? Why your face dey like this?
Solomon: Mtchew, oga leave me
Me: Which one be leave you?? You carry bad mood enter house, I dey ask wetin happen, you say make I leave you. Talk johr
Solomon: You no go understand bro. Food dey?
Me: Food? Food dey when you comot??...*checks nylon*... We no get food for house, you go dey buy soap. Shey you wan baff the hunger comot?
Solomon: Hmph...guy this money issue don tire me. Mtchew. See as we big reach, we no get even garri to drink for house. Omo!!...*Lies down on the bed*
Me: Oga talk to me na.. na wetin make your mood dey like this?? I think say you comot go find work?? Gist me na
Solomon: I wan sleep bro...later
Me: Solomon!! Solomon!! Solo!!
Solomon: *sleeps off*
Me: Ohhh...na like this abi??...no wahala, carry on...*lies down on my own side of the bed*
{Next morning}
Me: *wakes up*...Ahh, Solomon don wake up comot already. He no even wake me or tell person say he dey comot. No wahala...make me sef comot my own.
*Enters bathroom to bath*
Me: e good as he even buy soap sef, at least make person dey smell nice as hunger dey wlre am....*hangs towel and starts bathing*
{My phone rings twice, no answer...then WhatsApp message enters}
Me: *still bathing*...Omo who dey disturb me like this??...*stops bathing and opens WhatsApp message*
*WhatsApp message*...Solomon: Bro, sorry for how I take treat you yesterday night. Many things just dey my head, I dey really sorry bro. This no money issue don too much my guy. That yesterday wey I comot go work, no be work I go. Timothy carry me go meet one Baba like that for Osun. The Baba gimme soap say make I use am baff, if I baff finish l go run mad forever but my family no go lack money. Na the soap I carry come back so con dey think about am like that.
Omo this morning, I finally decide not to baff with am again sha π’.
ππ
Wetin I go do now
Credit: Stephen Joel